Monday, 25 August 2014

#UpGunnersPidginPodcast - (Monday Edition)

#UpgunnersPidginPodcast na online Radio show wey bros Tony Doe carry come!

2 times every week Monday and Friday, im go bring una team update, match review and preview, fan talk and dem dem...
If u be Arsenal fan and you wan participate for de show e no hard just take ya phone record ya expectation for Arsenal this season, talk ya name and twitter handle join send am to broadkasthussle@gmail.com

#PidginOnly

UpGunners... Gunners for life!!!
Na God save us on Saturday say we nor fall to de winsh wey Everton been cook keep for pot for we. Yeye pipo dem tink say na last season be dis? Nonsense!

Anyhow, we don survive dat wan, na to face Besiktas on Wednesday na im we dey plan...

Meanwhile make una enjoy dis podcast wey feature #voicenote from my pipo dem, @SenseiUche @Phatill (wey be Chelski fan) & music from top top gooner, @VectorThaVyper 

UP GUNNERS....!


Carry go!!!

WATCH PROMO (YOUTUBE)

LISTEN 

DOWNLOAD LINK (DROPBOX)

No comments:

Post a Comment